fbpx
May 5, 2024

“She don high” – Ini Edo cause buzz with new dance video

ini-edo-unexpected-dance-video-cause-buzz-online

Popular Nollywood actress, Ini Edo, don make tongues dey wag with unexpected dance video of herself.

Di 41-year-old mother of one enter TikTok share one video of herself as she dey dance dey rock brown romper.

As e be so, di video spark mixed reactions on top di TikTok app. Some pipo criticize her dance moves, dem tok say e no dey right for someone of her age. Others claim say she dey under di influence of drugs.

On di other hand, some pipo defend Ini Edo unexpected dance video, dem argue say na enjoy she just dey enjoy herself.

Weeks ago, inside recent interview with media personality, Chude Jideonwo, di actress yarn say she regrets say she marry.

 

FOR MORE NEWS: Gabon President, Ali Bongo No Dey House Arrest Again – Junta

 

Ini Edo marry one American-based businessman, Philip Ehiagwina, on November 29, 2008, but di marriage only last for five years, and they finally divorce in 2013.

When di interviewer as her why she regret settling down, Ini Edo admit say no be di right decision to make at dat time.

“I regretted my decision to get married because it wasn’t the right move to make,” Na wetin she tok be dat.

However, she note am say she go give marriage another shot “if di right person come.”

You fit go read di tori…READ MORE