fbpx
May 18, 2024

“Respect is earned…” – Paul Okoye lover, Ivy, tackle am over Instagram post about ‘respect’

ivy-tackle-lover-paul-okoye

Nigerian model and brand influencer, Ivy Ifeoma, don tackle her lover, singer Paul Okoye, after hin tok say di only di wey matter  to man na respect and no be love.

Di 41-year-old, wey recently go public with hin relationship with hin 22-year-old lover, bin tok for hin Instagram page for February say sometimes, all di thing wey man needs from hin partner na respect rather than love.

According to am, men no dey concerned about love, and respect na di only thing wey matter to dem.

“For Men… Sometimes it’s not all about love. RESPECT… is all that matters!!!” he wrote.

FOR MORE NEWS: Yemen: Over 80 people die for Ramadan stampede

Dis statement no sit well with Paul lover, Ivy, and she recently take to her Instagram stories to react.

She quote her lover and ask say wetin make a man partner different from any random person if all di thing wey matters to am na respect?

Also, she tok say men wey dey demand respect like say dia life depend on am need to know say respect na something to earned.

In addition, she advise dem make dem respect dia partners too and make dem stop to dey act like dog.

Her post don spark speculation say she and di singer dey currently go through rough patch for dia relationship.

You fit go read di tori as Ivy tackle her lover, Paul Okoye…READ MORE