fbpx
May 18, 2024

Josh2Funny wow audience as hin audition for America’s Got Talent

josh2funny-wow-audience-for-america-got-talent

Popular Nigerian comedian, Josh2Funny, don carry hin comedic performance go international stage as hin audition for di America Got Talent.

Di content creator fly go US to give do di audition for a chance to win $1,000,000, wey be di prize money wey go dey awarded to di winner of AGT.

Josh2Funny give three-stage performance; however, di judges, Simon Cowell, Heidi Klum, Sofa Vergara, and Howie Mande reject am from di beginning.

Hin first on-stage appearance na di quick reader wey fit read three books under a minute. As Josh dey read di books, hin murmur di words, but hin no impress di four reviewers.

 

FOR MORE NEWS: “No fuel, you wan go fight war. How you wan take reach battle field?” – Burna Boy shade Nigerian government

 

Before person know wetin dey happen, di judges send am comot from di stage. Dem no even allow am advance to di next round.

However, hin no give up; instead, hin do something wey dem no expect: hin return back with different clothes and different identity.

Di ‘fastest rapper for di world’ wey dey known as J Hush na Josh2Funny second act, and all di thing wey hin do na to murmur hin lines like say hin dey speed read.

Upon dat one, hin still receive No from Simon, Heidi, and di other two, na so dem pursue am comot again.

But, hin no still give up, hin return back di third time on di same day as a magician wey dey identified as Terrifying Jay.

Di comedian try to do magic with deck of cards, but Howie give am no buzzer before hin start sef.

Later, hin kon pull off mind trick on di presenter, Terry Crews, na dat one impressed Simon Cowell, wey on behalf of di other judges give am ticket to di next round.

You fit go read di tori…READ MORE