fbpx
May 18, 2024

“No fuel, you wan go fight war. How you wan take reach battle field?” – Burna Boy shade Nigerian government

burna-boy-tackle-government

Nigerian superstar singer, Burna Boy don tackle Nigerian government for considering military intervention for Niger Republic.

Di self-styled ‘Odogwu’ criticize di Nigerian Government during Instagram Live session on Tuesday, August 8, as hin dey tok about dia proposed plan to invade Niger Republic after military junta take over di nation governance.

Burna Boy, wey bin dey smoke weed, question how di federal government plan to invade di neighboring country with di matter of fuel subsidy crisis.

 

FOR MORE NEWS: Activist Timi Frank tackles Akpabio over ‘vacation allowance’ to lawmakers

 

“Fuel no dey, you wan go fight war. How you wan take reach battlefield?”  di question wey hin ask spark laughter among hin friends.

Also, for another news, Burna Boy receive big birthday surprise during stage performance for Netherlands.

Di self-styled ‘African Giant’ turn 32 on Sunday, July 2, but hin bin dey perform for di Down di Rabbit Hole’ festival for di European kontri.

You fit go read di tori see how Burna Boy tackle Government…READ MORE