fbpx
May 18, 2024

“You no know my story” – Yul Edochie second wife, Judy Austin don address critics

judy-austin-address-neteizens

Controversial Nigerian actress, Judy Austin-Edochie, don address neteizens wey dey throw insults and curse for her body.

Di actress wey don face online backlash since di tori come out say she be her colleague, Yul Edochie second wife, in April 2022 address her critics inside video wey she share on top her husband, Yul Edochie verified Facebook page.

E neva too tey wey Judy and Yul trigger wrath of netizens. Dis na after Yul share video of Judy thanking God for saving her during childbirth. Some social media users criticize di video as insensitive, as e come a few weeks after Yul senior wife lose her pikin.

Inside di new video, Judy first thank her fans for their unflinching support and love, before expressing gratitude to those who insult and attack her without knowing anything about her.

 

FOR MORE NEWS: Fan advise Chinenye Eucharia over appearance inside new photos

 

She explain say dia curses and insults don bring plenty of blessings from God into her life.

“To the people who hate me, curse me, or attack me without knowing anything about me, I want to say a very big thank you. Without your curses, God wouldn’t be blessing me as much as He is. Without your curses, I wouldn’t have come this far in life, so soon, so fast.” N apart of wetin she tok be dat.

Sharing di video on top hin verified Facebook page, Yul write, “IJELE ODOGWU! Judy Austin addresses those who are insulting her and cursing her.”

You fit go read di tori as Judy Austin address neteizens…READ MORE