fbpx
May 4, 2024

Fan advise Chinenye Eucharia over appearance inside new photos

netizen-advice-chinenye-eucharia

One netizen recently give advice to up and coming actress, Chinenye Eucharia after she post new images of herself on top Facebook.

After pipo kon know her because she bin dey adopted by well-known actress, Destiny Etiko, Chinenye eventually fall-out with di movie star, wey accuse her of disrespect.

For her part, she neva tok anything, she no wan reveal wetin happen.

 

FOR MORE NEWS: Davido don enter Acting, Hin Announce New Netflix Series

 

Inside recent development, she post some pictures of herself on top her Facebook page alongside a caption wey read:

“A Woman should be Two Things BOLD and Beautiful”

Reacting, one Facebook user identified as Edica Saeed wey notice say she don slim advise her make she go back to Destiny Etiko.

“You better go back to destiny etiko, you are getting slim,” N awetin di user write be dat.

You fit go read di tori as Netizen advice Chinenye Eucharia…READ MORE