fbpx
May 15, 2024

June 12: Lagos neva enjoy democracy dividends – PDP

june-12-lagos-neva-enjoy-democracy-dividends

Di Peoples Democratic Party, PDP, for Lagos State yarn say di residents neva dey enjoy di dividends of democracy despite di sacrifices of June 12.

Inside statement on Sunday, di opposition party advise pipo make dem dey patient and hopeful say di best dey on di way.

Di state neva enjoy real dividends of democracy, wey di late Chief MKO Abiola and di June 12, 1993, elections stand for.

Publicity Secretary, Hakeem Amode yarn say di residents “deserve more than wetin dem dey  experience under di ruling All Progressives Congress (APC).

 

FOR MORE NEWS: Fuel subsidy removal: I feel your pain, sacrifice a little more – Tinubu dey beg Nigerians

 

Also, di spokesperson yarn say Lagos dey blessed with both natural and human resources but e no get anything to show for am.

In addition, hin yarn say dis na state wey suppose set pace for others in education, health and other infrastructure based on her huge income.

Amode yarn say di authorities don fail to lift Lagos to an enviable level.

Di PDP promise say once dem take over power, di people “go enjoy dia wealth and money wey dem go na hin dem go use for di development”.

You fit go read  di tori on di matter wey tok say Lagos neva enjoy democracy dividends…READ MORE