fbpx
May 14, 2024

Fuel subsidy removal: I feel your pain, sacrifice a little more – Tinubu dey beg Nigerians

Tinubu-dey-beg-Nigerians

President Bola Tinubu dey beg Nigerians, hin don admit say di recent removal of fuel subsidy don put hardship on di general public.

Tinubu tok for hin maiden Democracy Day address to Nigerians on Monday say though hin feel di pain of di masses, but dem need to sacrifice more for the betterment of di entire nation.

According to di president, di temporal discomfort wey di feul subsidy removal cause, dey necessary to save di country from going under.

 

FOR MORE NEWS: Hin deserve hin ordeal – Traders dey celebrate Emefiele suspension

 

Also, hin yarn say dis na one decision wey we must bear to save our country from going under and so dat we go take our resources comot from di from stranglehold of some unpatriotic elements.

In addition, as Tinubu dey beg Nigerians, hin admit say di decision go impose extra burden on di masses of our people. However, hin ask hin compatriots make dem sacrifice a little more for di survival of our Kontri.

You fit go read di tori…READ MORE