fbpx
May 9, 2024

Electric shock Midnight thief to death for Unizik

electric-shock-thief-for-unizik

Electric shock one yet-to-be-identified man to death wey dem suspect to be thief for di Nnamdi Azikiwe University for Awka, Anambra State, UNIZIK.

According to report, di incident happen around di Faculty of Education building, wey dey close to di Department of Economics of di university.

Na for midnight on Monday na hin di incident happen.

Also, evidence show say di thief bin don almost cut di high-tension cable finish before di Enugu Electricity Distribution Company (EEDC), kon bring light, na so electric shock kill di man.

As of di time of filing dis report, EEDC officials, policemen, and officials of di Safety Department of diUniversity bin dey try remove di lifeless body of di suspect from di electric pole where hin hang.

 

FOR MORE NEWS: Energy Nigeria biggest problem – Economist, Williams

 

In addition, one source for di di university yarn say as dem come di school on (Tuesday) morning.  According to di source, di body hang from di electric pole for transformer point for di area of di new Faculty of Education building, close to di Department of Economics.

Also, di EEDC officials, policemen, and officials of di Safety Department of di University bin dey on ground as some pipo try remove di body from di pole around 11 a.m. on ( Tuesday).

However, di State Police Public Relations Officer (PPRO), DSP Ikenga Tochukwu, neva confirm di incident as of di time wey dem file di report.

Electric shock thief for UNIZIK, You fit go read di tori…READ MORE