fbpx
May 3, 2024

ASUU: Make Dem Give Students Grants, No Be Loans!

asuu-no-want-student-loans

ASUU wey dey for Bauchi State don talk again say dem no want student loans, make dem give grants instead to fund students’ education.

Di Bauchi Coordinator of ASUU, Associate Professor Lazarus Maigoro, talk dis one as dem give scholarship to 19 undergraduates wey dey struggle for money for the Abubakar Tafawa Balewa University (ATBU), Bauchi.

Prof. Maigoro talk say, “The question be: who go fit pay this loan? Wetin go happen to those wey no go fit collect am? The wahala wey go dey disturb students psychologically because of loan while dem dey study go spoil their performance.

“The fear say dem go graduate with loan wey pass N4 million and dem no go fit pay back na another wahala for their mind.”

 

FOR MORE NEWS: “Burna Boy Sacrifice Im Manhood” – Twitter User Yarn, Talk Say Artist No Born Pikin by 30.”

 

E talk say the Bauchi zone of ASUU dey work to gather the number of students wey fit waka comot from school after this session finish. Dem dey hope say if government see the number wey go drop out, e fit make dem change their mind about the loan matter and decide to give grants instead.

ASUU Chairman for ATBU branch, Comrade Ibrahim Inuwa, talk for im welcome message say, dem go continue to dey act like socially responsible organization wey dey fight for beta education for higher institutions.

ASUU no want student loans, na grant beta, You fit go read di tori…READ MORE