fbpx
May 5, 2024

NPFL: Kano Pillars Dey Find New Coach Ahead Of New Season

kano-pillars-dey-find-new-coach

Upon say di club earn promotion ticket to Nigeria Premier League after di season for di Nigeria National League (NNL), Kano Pillars, dey find new coach ahead of di new season.

A statement from di club Media Officer, Alhaji Rilwanu Idris Malikawa, confirm di dissolution wey dey in line with di technical crew’s contractual agreement with di club wey expire at di end of di just concluded 2023 Nigeria National league season.

Also, in swift reaction, di new Technical Committee set up by Kano Pillars management don ask interested coaches within and outside Nigeria wey wish to work with di club make dem submit dia application to di club secretariat from now to 22nd July 2023.

Dis tori dey disclosed by di committee Chairman Engineer Usman Mustapha shortly after dem receive dia appointment letters from di Chairman of di club Alhaji Babangida Umar Little.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu to submit list of ministerial nominees

 

In addition, engineer Usman Mustapha inform dem say interested candidates fit submit dia application directly to di club Secretariat for Sani Abacha Stadium Kofar Mata, Kano or through di official e-mail of di club (kano.pillars@yahoo.com).

He yarn say di committee go do dia best to ensure say only qualified coaches with good records dey recruited without any sentiment.

You fit go read di tori see why Kano Pillars dey find new coach…READ MORE