fbpx
May 5, 2024

Napoli offer Osimhen N6.5bn annual salary to remain for di club

napoli-wan-keep-osimhen

Serie A champions, Napoli wan keep dia man and top scorer from last season, Nigerian striker, Victor Osimhen, and dey do everything possible to make am happen.

Osimhen dey on di radar of top European clubs following hin outstanding performance.

Now, di club don  offer Osimhen new two-year contract extension with a salary worth N6.5bn — €6.5m plus €1m in bonuses, according to reports.

Skysports report on Monday say Napoli dey in advanced discussions to extend hin (Osimhen) contract until 2027 with an increase in salary.

Osimhen wey get two years left for hin contract bin earlier request an improved deal with €7 million. However, Napoli now don table dia offer wey comes with a release clause of £170m.

 

FOR MORE NEWS: NPFL: Kano Pillars Dey Find New Coach Ahead Of New Season

 

Also, Napoli new manager, Rudi Garcia don confirm say Osimhen go remain for di club ahead of di new season.

Hin tok say hin don tok to Osimhen wey wan stay here to make another great season with Napoli.”

“I can assure you that he (OsImhen) wants to stay, he is happy to be with us and still wants to do great things.” Na wetin hin tok be dat.

Osimhen score 26 goals plus five assists for 32 league appearances for Napoli last season.

You fit go read di tori see why Napoli wan keep Osimhen…READ MORE