fbpx
May 18, 2024

Kate Henshaw criticize senators over holiday allowances

kate-henshaw-criticize-politicians

Popular Nollywood movie star, Kate Henshaw criticize politicians as she maintain say di only ‘prayers’ wey struggling Nigerians dey get na more burdens and taxes to pay.

Dis matter dey come in reaction to di Senate President, Akpabio revelation during di plenary session on Wednesday, when hin tok say dem send “prayers” to hin colleagues as dem dey go on holiday.

“In order to enable all of us to enjoy our holidays, a token has been sent to our various accounts by the Clerk of the National Assembly.” Na wetin Akpabio tok be dat.

Although, hin later change wetin hin tok, hin rephrase am as  “prayers” wey dem send to dia “mailboxes” instead of di suppose  allowance.

 

FOR MORE NEWS: “Natural born winner”- Comedian, Ayo Makun boast as hin relocate to US

 

Many Nigerians bin vex as dem hear di comment, particularly on social media. Dem yarn say politicians dey wicked to poor Nigerians.

Kate Henshaw follow criticize di politicians’ lack of concern for struggling Nigerians.

She wrote:

“The only “prayers” going into the “mail” of Nigerians is more taxes, more burdens, more “grin & bear it”, more “we don’t give a f@#k”.

Happy holidays to the ones meant to serve & bring succour to their constituents. Nothing do una jare.

“What’s the worst that can happen? Morning”

You fit go read di tori see as Kate Henshaw criticize politicians…READ MORE