fbpx
May 18, 2024

“Fire dey my head, no try am” – Angel dey para for Ceec over offensive statement

housemates-argue-over-statement

Tension rise for BBNaija All Stars house as housemates Angel Smith and Ceec dey argue over Biggie statement about dia productivity during movie-making duty.

Di argument start when di housemates receive task of writing and filming movie together.

Dissatisfaction grow among participants on Thursday morning as di script progress fall short of expectations.

Ceec, wey dey known for her uncensored thoughts, pour out all her anger with comment wey kon put fire for di heated argument.

 

FOR MORE NEWS: Kate Henshaw criticize senators over holiday allowances

 

Part of wetin she tok na, “the housemates are full of shit,”. s she tok dat one, she bin dey refer to di lack of passion and commitment on di part of di other housemates.

Also, Angel Smith, wey be one of the housemates, kon vex as she hear dat statement from Ceec.  Na so Angel waka go where Ceec dey, she accusing Ceec say she no dey consider di efforts of other housemates.

If you even see Angel face, you go know say she bin dey vex well well, and she no hold am back.

You fit go read di tori see as Housemates dey argue over biggie statement…READ MORE