fbpx
May 7, 2024

Kebbi Gov Swears In 26 Commissioners

kebbi-governor-swear-in-commissioners
Governor Nasiru Idris of Kebbi State don swear in 26 commissioners and members of di state executive council. 
Hin charge di new commissioners say make dem keep to di expectations of di electorate and live up to dia assigned responsibilities.
As di Kebbi Governor swear in commissioners for di Banquet Hall of di Presidential Lodge for Birnin Kebbi, di governor give warning say any of di commissioners wey fail to discharge dia responsibilities go dey removed.
Also, hin direct di new commissioners make dem go dia respective ministry so dat dem go start work immediatly for di betterment of di people of di state.
HIn addition, hin yarn say dia appointments dey based on dia track records and service to di state and hin encourage dem say make dem mingle with di pipo for dia respective local governments so as to know dia  needs and challenges for di government to tackle.
You fit go read di tori…READ MORE