fbpx
May 5, 2024

I no receive any prayers – LP Senator, Kingibe react to Akpabio remark

kingibe-react-to-akpabio-remark

Senator Ireti Kingibe wey dey represent di Federal Capital Territory, FCT, Abuja for di Senate follow react to Akpabio remark,  she tok say she neva receive any ‘prayers’ for her email from di Senate President, Godswill Akpabio.

Kingibe, a Senator under di platform of di Labour Party, LP, bin dey react to Akpabio assurance during di day plenary session wey hin tok say dem don send “prayers” to lawmakers as dem wan go on dia vacation.

Di Senator tok on Wednesday as camera carry am on top Channels Television’s Politics Today programme. For there, she maintain say she no receive any allowances wey dey out of di ordinary.

 

FOR MORE NEWS: SERAP threaten to sue Akpabio over senators’ holiday allowance

 

You fit remember say di Senate President during di Senate plenary session on Wednesday tell Senators, say dem go receive token for dia accounts from di Clerk of di National Assembly for dia holiday.

However, Akpabio later withdraw di statement, hin describe di supposed disbursement as “prayers” wey dey sent to dia “mailboxes”.

Also, even as hin acknowledge say most people fit don assume say hin send allowances to di lawmakers, Akpabio explained say dat kain payments na money wey dem go still pay.

You fit go read di tori see as Kingibe react to Akpabio remark…READ MORE