fbpx
May 5, 2024

Presidential Election Tribunal: Nigerians dey worry as dem wait for judgement day

PEPT-Justices-to-deliver-ruling

As di five Justices wey hear di election petitions filed by di candidates of di Peoples Democratic Party (PDP), Alhaji Atiku Abubakar, and di Labour Party (LP), Mr. Peter Obi, for di presidential election petition tribunal, PEPT, challenging di victory of President Bola Tinubu for di February 25 presidential election, prepare to deliver dia ruling on di matter, Nigerians wey dey home and in Diaspora dey expect say di judges go rule based on di facts and figures wey dey presented before them and not based on technicalities or any other consideration.

Also, you go remember say di Independent National Electoral Commission (INEC) on March 1, four days after di presidential election wey hold on February 25, bin announce Asiwaju Bola Ahmed Tinubu of di All Progressives Congress (APC) as di winner of di election and president-elect.

 

FOR MORE NEWS: “Fire dey my head, no try am” – Angel dey para for Ceec over offensive statement

 

According to di INEC Chairman, Prof. Mahmood Yakubu, Tinubu poll 8,794,726 votes to beat Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP), wey come second with 6,984,520, and Peter Obi of di Labour Party (LP), wey dey third with 6,101,533.

Di INEC Chairman stress say by that score, Tinubu bin meet di first constitutional requirement of garnering di highest votes among all di candidates. Also, hin yarn say Tinubu score over 25 percent of di votes cast for 30 states, and e dey more than di 24 states wey dey constitutionally required.

You fit go read di tori as see as PEPT Justices prepare to deliver ruling…READ MORE