fbpx
May 4, 2024

‘Bullying na hin make me anti-social” – Kizz Daniel

kizz-daniel-experience-bullying

One well-known artist,  wey pipo sabi as Kizz Daniel, don come out claim say na bullying wey hin experience when hin small na im make to socialise with pipo dey hard for am.

Hin claim say when hin still small, di other pikin for hin yard dey always bully am and dem dey take am do yeye because hin bin dey overweight.

Inside hin most recent episode of di Afrobeats Podcast, wey bin dey hosted by Adesope Olajide, di “Buga” singer Kizz Daniel reveal all di tori about di bullying experience.

Kizz Daniel yarn say hin don build hin own world for hin head since hin still small. Because growing up, na fat pikin hin be.

 

FOR MORE NEWS: Mohbad worth na $690k, Naira Marley still dey owe am about ₦300 million – Kemi Olunloyo

 

Also, hin tok say, as hin bin fat, hin no dey like comot because di other children for di area dey use am do yeye.  Every time dem go dey call am orobo and dem go dey bully am.

Hin tok say during dat time, hin dey always stay indoors,and hin don already build dis fantasy world for hin head. In addition, hin tok say di world wey hin build for hin head, na very comfortable space for am.

“So, as hin reintroduce himself to di world after hin lost weight; hin see say hin don lose all hin social skills. Also, hin no know how to communicate. And hin no know how to socialise with people.”

You fit go read di tori…READ MORE