fbpx
May 18, 2024

Gov election: Elders council raise alarm over Kogi political violence

kogi-elders-council-raise-alarm

Chairman, Kogi East Elders Council, Arch Gabriel Aduku, don raise alarm over tension wey come out from di forthcoming governorship election for Kogi State, and hin call relevant authorities make dem come check di situation to save people from violence.

Aduku, wey also be chairman of Arewa Consultative Forum, ACF, yarn say di election scheduled for November 11, 2023, fit no hold if violence continue.

Adukwu inside interview with journalists after meeting with di staff of ACF for Kaduna, yarn say di coming election for Kogi State no  only be sensitive matter but na something of grave concern, in view of di insecurity for di state.
According to am, Kogi State dey faced with insecurity for di past few years, even for di beginning of dis democracy and e dey worse everyday.

 

FOR MORE NEWS: Forex scarcity continue as CBN resume intervention

 

Also, hin tok say e dey very scary to go into di election, e don becomes concepts of violence, concepts of destruction, dis na wetin pipo dey tok openly now.

In addition, hin yarn say di insecurity no even good for dia relationship as a state. Some of dem dey privileged to know how Kabba province bin dey, and how dem relate very well under the regional government. And now na State and dem get resources wey God plant for di state for dem to use

You fit go read di tori see more tori on why Kogi Elders Council raise alarm…READ MORE