fbpx
May 18, 2024

Ex-SDP Presidential Candidate Caution Tinubu On Essential Commodities’ Cost

sdp-presidential-candidate-advise-tinubu

Social Democratic Party (SDP) presidential candidate for di last election, Adewole Adebayo don advise President Bola Tinubu make hin no go allow di costs of essential commodities and services go gallop away.

He advise di president say make hin no allow praise singers push am to summon two “dragons of hyperinflation and unemployment” to a duel.

Also, Adebayo on top hin twitter handle yarn say hyperinflation and ego inflation of government macroeconomic planners carry inflation come di kontri together.

He tok say di mutually feeding simultaneous inflations wey dey affect Nigeria riht now na hyperinflation for di economy and ego inflation of government macroeconomic planners. Also, hin tok say No matter wetin dem model for econometrics, make dem never let costs of essential commodities and services gallop comot.

In addition, hin yarn say di thing wey  BATonomics dey enter now na wetin Fela Anikulapo Kuti sing about ‘trouble dey sleep, yanga wake am. Wetin e dey fin? Wahala e dey fin’”. @officialABAT better not let praise singers egg him on to summon two dragons of hyperinflation and unemployment to a duel we can’t win.” na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori see as SDP presidential candidate advise Tinubu…READ MORE