fbpx
May 18, 2024

Tonto Dikeh don vow say she go still compete for elections until she win

tonto-vow-to-compete-for-elections-untill-she-succeed

Notable actress-turned-politician, Tonto Dikeh don vow say she go still compete for elections. Also, she express her determination to continue to participate for elections until she achieve victory.

As she don contest before as deputy governorship candidate for di African Democratic Congress during 2023 Rivers State elections, Tonto Dikeh acknowledge say her prospects of governing di oil-rich state for di future no sure because of di nature of politics.
She tok dis matter during interview with journalists for Abuja for GOTNI national leadership conference, wey bin dey organized by di National Leadership Centre under di  theme of “Leadership for Sustainability.”

According to her, One of di things wey she learnt for contesting election na resilience and to never give up.

Also, she believe say Nigerian youths need great leadership, particularly for dis time wey dem dey fight for better Nigeria and more prosperous life.

You fit go read di tori read  why  Tonto vow to still compete for elections…READ MORE