fbpx
May 3, 2024

14-day strike notice: Federal Government and Labour no gree on peace deal wey dem cancel.

labour-threaten-to-start-strike

Federal Government and Labour don start to yan ‘gbege’ for obodo Naija as government no gree di nationwide strike wey Labour threaten to start for di next 14 days sake of say dem believe say government no follo dia agreement for di memorandum of understanding wey dem sign with Nigeria Labour Congress and Trade Union Congress for October 2023.

Also, Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, talk for interview with The PUNCH say make Labour calm down small and allow government address dia gbas-gbos issh.

Im talk say, “Make Labour get patience. We go check di things wey dey shake well-well. Make dem come yarn with us sake of di betterment of our country.”

However, Idris no talk whether government go carry di matter go court to stop di strike.

 

FOR MORE NEWS: Omotola Jalade Celebrates 46th Birthday, Congratulations Flow In

 

After di matter of fuel subsidy wey President Bola Tinubu cancel for May 29, 2023, Labour and government bin agree for some tins to make e no too hard for workers.

Dem agree say all federal workers go dey collect N35,000 from last September till dem approve new minimum wage law. Dem talk say states fit extend dis benefit to dia workers too.

Government still promise say dem go provide 100 CNG buses for country to reduce high transport cost.

Labour come vex talk say government no fulfil dia promises after five months. Di workers don give government 14 days from February 9 to February 14, 2024. Dis na for dem to do wetin dem bin agree for di MoU.

Different unions like di Nigerian Union of Banks, Insurance and Finance Institution Employees and di Air Transport Senior Staff Association don talk say dem go join di strike if government no do wetin dem promise.

You fit go read di tori see why Labour threaten to start strike…READ MORE