fbpx
May 19, 2024

Lagos govt go start to detain vehicles without license plates

law-enforcement-go-detain-vehicles-without-plate-number

Di Lagos State Government, yesterday, direct law enforcement agencies make dem arrest motorists with wey no get vehicle registration number plates and those ones wey no get any number for dia vehicles. Na so e go be from now, law enforcement go detain vehicles without number plate.

Inside chat with newsmen, di Permanent Secretary, Ministry of Transportation, Mr Abdulhafiz Toriola, note am say wrongful use of number plates don dey rampant.

Toriola, wey cite Section 16 of di Lagos State Transport Sector Reform Law of 2018, yarn say vehicle without number  na di type of vehicles wey some pipo dey take commit crimes because dem no go fit track dem.

 

FOR MORE NEWS: Gov Kefas, PDP express shock over di death of party chairman

 

Also, hin yarn say di purpose of using number plate na for proper identification and security as e dey personalised for each vehicle.

As di matter be now, di law enforcement agencies don give order say make dem arrest any vehicles wey default.

Also, hin advise vehicle owners make dem comply with di State Government to strengthen di security architecture wey dey in place already.

You fit go read do tori see why law enforcement go detain vehicles without number plate…READ MORE