fbpx
May 26, 2024

Tinubu go open 63rd NBA Conference for Abuja

tinubu-go-open-di-63rd-nba

President Bola Tinubu go open di 63rd Annual General Conference of di Nigeria Bar Association NBA for Abuja dis weekend.

Di decision to declare di event open follow di invitation wey di President receive from di leadership of di Nigerian Bar Association (NBA), led by Barrister Yakubu Maikyau, SAN.

Also, as hin play host to di delegation for di Presidential Villa on Friday, Tinubu pledge say hin administration go conclude thorough review of di remuneration templates of judicial officers for di kontri.

According to di President, di battle against corruption na hin make dem bring up di comprehensive review of the salaries and allowances of judicial officers. Dis na an issue wey dey well known to am because of hin landmark success in reforming justice administration for Lagos State.

 

FOR MORE NEWS: We no accept dishonesty for our household — Celebrity couple, Adekunle Gold and Simi reveal

 

Also, President Tinubu acknowledge di importance of addressing di current vacancies within di Supreme Court. Hin yarn say di vacancies represent obligations wey suppose dey fulfilled based on recommendations by di National Judicial Council (NJC).

In addition, President Tinubu still acknowledge di privilege of di plenty lawyers wey hin get as close aides. Hin get lawyers like Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, di State Chief of Protocol, Victor Adeleke, and hin Principal Private Secretary, Prince Damilotun Aderemi.

You fit go read di full tori see why report tok say Tinubu go open di 63rd NBA…READ MORE