fbpx
April 26, 2024

Naira Redesign: Lagos lawyer don drag Emefiele go court

Lagos-based-lawyer-initiate-proceedings-against-Emefiele

Barrister Tope Alabi, a Lagos-based lawyer don approach di Federal High Court for Lagos State to initiate proceedings against di governor of Central Bank of Nigeria CBN, Godwin Emefiele for claims of disobeying di Supreme Court orders on di naira redesign policy matter.

Di lawyer make di application via a March 27 ex parte motion for di suit wey di CBN governor list as di sole respondent.

Also, dem describe di CBN cashless policy as a “cash confiscation policy”. In addition, Alabi yarn say di Naira scarcity don affect di day-to-day running of hin office.

As di Lagos-based lawyer initiate proceedings against Emefiele for court, hin yarn say hin staff no fit come work everyday following di non-availability of cash.

FOR MORE NEWS: PDP crisis: ‘I will fight you till I leave office’ – Wike dey mock Ayu after removal

He add say commercial drivers no get point of sale (POS) devices/machines to collect fares,and na hin make hin staff no fit access di office.

Di lawyer file a 28-page affidavit in support of hin application where he claim say di Supreme Court on March 10 2023, for Suit No. SC. 162/2023, “bin ask Emefiele make hin make available and allow di old N200, N500 and N1000 notes to co-exist as legal tender with di new N200, N500 and N1000 notes till December 2023.”

You fit go read di tori…READ MORE