fbpx
April 26, 2024

PDP crisis: ‘I will fight you till I leave office’ – Wike dey mock Ayu after removal

wike-mock-ayu-after-removal

Rivers State Governor, Nyesom Wike don mock di former National Chairman of di Peoples Democratic Party, Iyiorchia Ayu, following hin suspension from di party by di Benue State branch of the PDP.

Wike, wey tok on Tuesday (today), during di commissioning of di first phase of di Trans-Kalabari road for Degema Local Government Area of Rivers State, yarn say Ayu no fit preside over dem for di party, especially as hin fail to win election for hin unit, ward and state.

As Wike dey mock Ayu following di suspension, hin yarn say Ayu bin tok say nobody fit suspend am, but today he don packed out from di office. And now dem get active chairman now. “I told him, you will go, whether he likes it or not”. Na wetin hin tok be dat.

FOR MORE NEWS: Gospel singers, Mercy Chinwo and Minister GUC don unfollow dia sef for Instagram

Di Rivers Governor yarn say he go continue to fight for Ayu removal till di end of hin administration. Hin add say hin ready for di battle.

A High Court for Makurdi, di Benue State Capital, don restrain Ayu from parading himself as di National Chairman of di PDP.

Ayu, on Tuesday, step aside in compliance with di court order.

You fit go read di tori…READ MORE