fbpx
March 28, 2024

Lewandowski don chop three match ban

0

Poland and Barcelona striker, Robert Lewandowski, don chop ban for three Barca games after hin collect red card for LaLiga 2-1 victory against Osasuna last week.

Lewandowski,wen dey with Poland for di 2022 FIFA World Cup for Qatar, collect two yellow card during Barcelona match against osasuna.

U FIT ALSO READ Transfer: Dem don ban Barcelona from signing new players for January window

Di second yellow card wen hin against Osasuna na becos say hin give David Garcia elbow for face.

Di 34-year-old go miss di La Liga match beetwin Barcelon and Espanyol, Atletico Madrid and Getafe after hin come back from di World Cup for Qatar.

Lewandowski’s teammate Gerard Pique him self chop four-game ban after hin bin complain about di match,con still insult di referee join for half-time.

Pique chop ban con use di opportunity to retire from football after dat game.Who go con pay for Gerald Pique ban only God know…

Although Barcelona don tok say dem go follow Spanish football association yarn to comot di ban against Lewandowski.but for Gerald Pique ban dem go go settle dat one for dia family house.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *