fbpx
March 29, 2024

Super Eagles don turn Super Chicken as Fans react to 4 – 0 defeat against Portugal

0

Nigerians on social media don react to di international friendly of super Eagles against portugal 4-0 defeat on Thursday night

According to tori for first-half Bruno Fernandes nak two goals enter Nigeria net and for second-half Goncalo Ramos and Joao Mario self nak anoda two goals for Nigeria net to take hold bodi

U FIT ALSO READ Lewandowski don chop three match ban

Di match wen bin take place for Estádio José Alvalade for Lisbon
Some Nigerians ontop Twitter don come out pour dia mind out over di outcome of di result,

Some of dem tok say di thing pain dem well well but dey thank God say Super Eagles no qualify for di 2022 FIFA World Cup for Qatar if not wetin we for dey tok.

While some pipol criticize Emmanuel Dennis say na nonsense game hin play against Portugal on Thursday night.

Some don dey beg NFF to sack di Super Eagles coach, Jose Peseiro, while some tok say Bright Osayi-Samuel and Samuel Chukwueze na di only players wen perform well well for di match.

See pipol comment and reaction below…

@Mohnice_, “You Look at how the Portugal vs Nigeria game is going on and you thank God the super eagles didn’t qualify for the world. Because I don’t think there is a team we can manage to beat with these bums called footballers.”

@IfeoluwaIsaac2, “Bruno Fernandes has forgotten most, or his fans are Nigerians… He’s singlehandedly tearing our National team apart

@dezfootie, “Only positive for Nigeria in this 4-0 loss to Portugal is debutant Bright Osayi-Samuel. Faced with the daunting task of silencing PSG’s Nuno Mendes & he did so in brilliant fashion. Conceding & later winning a penalty.”

@Regular_NiceGuy, “The sad thing about the Portugal vs Nigeria match is that Nigerians don’t even have light to watch the match.”

@PoojaMedia, “Are “most” Super Eagles players overrated? Because why are we playing like this?”

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *