fbpx
May 5, 2024

EPL: Why I leave Chelsea for Newcastle – Lewis Hall

lewis-hall-join-newcastle

Lewis Hall don explain hin decision to leave Chelsea to join Newcastle United on season-long loan deal.

Also, Lewis Hall, wey agree on new six-year contract to stay for Stamford Bridge, officially join Newcastle from Chelsea on Tuesday.

As hin react after hin join Newcastle, di 18-year-old defender suggest say hin join di Magpies because hin be fan of di club as hin dey growing up.

Hall tell Newcastle website say hin dey very proud. Hin tok say him and hin family na Newcastle fans, also di Newcastle na big club and hin no fit wait to start.

 

FOR MORE NEWS: Election Tribunal dismiss petition against Reps Deputy Speaker Kalu

 

“To now be here at Newcastle, the club that I have supported since I was a kid, I am honoured and very proud to wear this shirt.” Na wetin hin tok be dat.

In addition, hin yarn say e dey very exciting. Also, hin tok say if person look back on last season and di way wey di team perform – dem go see say no be di results alone, but di performances wey di team put in.

Hall tok say plenty talented players dey di club and dem get di Champions League now too.

You fit go read di tori…READ MORE