fbpx
April 27, 2024

Nigeria no fit continue to borrow – Lawan

Nigeria-no-fit-continue-to-borrow-Lawan

Di heat for different revenue-generating agencies go soon go up to enable better revenue wey go fund di implementation of di N21.83tn 2023 budget. Na Senate President, Ahmad Lawan open up about this update. Hin yarn say na di Upper Legislative Chamber go do am, Nigeria no fit continue to borrow.

Lawan tok am for hin 64th birthday celebration, hin tok say e no go be business as usual for di revenue-generating agencies for naija because di government no fit dey borrow money put for di budget.

Hin still tok say aside from insecurity palava wey government don dey tackle, lack of sufficient revenue for di execution of national development programmes na another challenge. If dem want make di borrow borrow stop, dem go need to take time tackle di problem very well.

FOR MORE NEWS: Local printers go sue INEC – Ballot paper

Government no fit dey borrow every year because things no go fit work like that. Lawan add say dem go need to look wetin dey inside, find way bring money wey dem go use execute landmark projects and to fund infrastructures.

E say di government go review di processes of granting corporate tax holidays, import duty waivers and concessions to investors and businesses for di Federal Government.

All this tok na part of di reason why hin tok say Nigeria no fit continue to borrow.

You go like read di full tori..READ MORE