fbpx
April 25, 2024

Madam con explain how N206bn take appear for my 2023 budget proposal – Sadiya Farouq writes Finance Minister

0

Di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, headed by Sadiya Umar Farouq, don write letter to di Ministry of Finance, Budget and National Planning, headed by Mrs Zainab Ahmed, to explain di N206 billion wen she add join di 2023 Appropriation Bill.

Farouq tok say she no know anything about di huge figure and how e take enter di 2023 budget proposal.

U FIT ALSO READ Naira redesign: CBN, banks don ready for transition

She tok say no bi only Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management, and Social Development who dey accuse di Finance Ministry of budget padding.

Di Minister of Defence, Maj. Gen. Bashir Magashi (retd), hin self don call di attention of di Senate during budget defence sessions, hin tok say di finance ministry don add extra N11bn into hin 2023 budget proposal.

Di Minister of Health, Dr Osagie Ehanire, hin self don point finger to Finance Ministry dey accuse dem for padding hin ministry budget proposals.

Sadiya Umar Farouq, tok say she bin dey Worry about dat kind development.

Di Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq, inside di letter way she write on Wednesday November 23,2022, send to di Federal Ministry of Finance, insde di letter tok say she want di finance ministry to con explain how dat kind of amount come into her 2023 budget proposal.

According to one source from di Finance and Accounts Department of di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development,we hear say dey don send di letter on Wednesday immediately afrer dem write am to the finance ministry.

On top di same mattar one of di top policy maker for di ministry,who no wan mention hin name to the public, tok say Sadiya Farouq was embarrassed wen di senate commitee  ask her to explain di amount way dey appear on top her ministry 2023 budget proposal for National Assembly.

Di minister tell di senate committee say she self no know.how di N206 billion take enter di ministry budget proposal.infact as una see am no so me self see am na wetin di minister tell di Senate committee bi dat

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *