fbpx
April 26, 2024

Marketers don give warning about petrol price increase

0
petrol-price-hike2

Oil marketers, on Thursday, don send serious warning to di public, dem yarn say make dem expect to buy petrol at ‘any price’.

Marketers, under di support of di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, yarn say di Nigerian National Petroleum Company Limited no gree give their members products.  Dem yarn say dem buy am N205 from third parties.

National Controller Operations, IPMAN, Mike Osatuyi, yarn say di members of di association buy di products for N205 and dem go add N13 transportation to di cost.

Na wetin dem yarn be this: “NNPC no gree give us fuel. Na from third parties we dey buy and we fit sell am at any price. If di landing cost to our stations na N218 per litre, how much una expect us make we sell? So make di public expect fuel at any price, depending on di area,”.

Spokesperson for the Major Oil Marketers Association of Nigeria, Clement Isong, yarn on Wednesday say di association don hold logistics meeting with the NNPC.

This tori dey inside Punch…READ MORE

For more news: We don recover up to $1bn looted funds since 2015 —FG

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *