fbpx
April 19, 2024

Reason Why PDP fit no win South West, South East – Fayose

0

Di former governor of Ekiti State, Ayodele Fayose, don tok hin mind over di chance of di People’s Democratic Party, PDP, say to win South-West and South-East region for di forthcoming 2023 presidential election go dey slim.

Fayose yarn dis one for one interview with Channels Television on Politics Today on Thursday.

U FIT ALSO READ Nigeria dey sick, Na Atiku bi di cure – Demola Olarewaju

Hin tok say PDP go just dey deceive pipol say dem go win South-West Na big lie oo.
PDP tok say dem go win South-East. South-south dat one hin no fit say but any how e bi hin believe say north go dey tight well well.

Fayose tok say both PDP and APC, go work very bard to win di heart of pipol wen dey for north-central.

“PDP and APC no pick any candidate, either presidential or vice-presidential, from di north-central.

For di case of Adamawa state, na APC get am becos dem get another Kwankwaso wen fit delivere north give dem

Fayose still chook mouth for Peter Obi, of di Labour Party matter, hin yok say Obi fit affect di chances of di (PDP) for dis coming 2023 election.

Hin tok say if PDP fit Reconcile or negotiate with Obi and wike he go dey helpful well well for dia party.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *