fbpx
May 18, 2024

Man break up with girlfriend because she dey too independent and hin no fit control her

man-break-up-with-hin-girlfriend-because-she-dey-too-independent

One man end hin relationship as hin break up  with hin girlfriend because she dey too independent and hin dey fear say hin no go fit control her.

Screenshots of dia WhatsApp chat dey circulate online as di matter be so. Also, di matter don spark mixed reactions from social media users.

Inside di chat, di woman asked her man if hin buy di food wey she send to am. Also, she mention say she go send am necklace and slippers di next day.

In response, di man praise her for being a great girlfriend but hin point out say hin dey struggle with her independent nature.

Also, hin yarn say hin feel useless and hin no feel like man for di relationship, and hin dey fears say hin no go fit control her. According to am, hin no fit marry person wey no go dey submissive.

 

FOR  MORE NEWS: Nigerian woman celebrate as her sister welcome twins after 22 years of marriage

 

Inside other news, popular Lagos socialite, Farida Sobowale of House of Phreeda, don tok for di first time following her rescue from suicide attempt for di Third Mainland Bridge.

According to report wey bin come out before, person rescue di mother of three on Thursday evening, August 17, after she attempt to end everything.

She go di bridge inside her Lexus SUV, na so she come down, and make attempt to jump inside di lagoon when one passersby save her.

Following her recent suicide attempt, Farida release video admit say she do am because of her deep love for her ex-husband.

You fit go read di tori…READ MORE