fbpx
May 18, 2024

“Hakimi mama no dey like Nigerian mama” – Man warns

man-give-warning-on-hakimi-matter

One man don refresh di memories of pipo wey wan copy di popular footballer Achraf Hakimi by leaving dia wealth with dia Nigerian mama.

Nigerians, especially the men, dey rejoice over how di Moroccan football star outsmart hin wife for dia equitable distribution of assets following dia divorce.

Since Hakimi get all hin properties for hin mama name, di thing make am impossible for hin wife to collect di properties, some men sef don decide to follow after hin footsteps.

FOR MORE NEWS: Sowore don raise alarm over Tinubu health and whereabouts

One netizen don remind men about how dia Nigerian mama no dey gree give back wetin dia pikin give dem to hold.

He refresh dia memories about how mothers go always withhold wetin dia pikin give dem  and still imposing dia rights on di thing because na dem be di mama.

You fit go read di tori of di warning wey di man give as Pipo wan copy Hakimi…READ MORE