fbpx
April 26, 2024

Man-United fall yakata inside Old-Trafford

0

No be the kind start wey the red devils fan go wan see happen inside old-trafford today. Only God know wether Brighton carry okro go field take play Manchester-United, as the team fall yakata in front of fans wey think say this season go be better season.

Shame self cash Erik ten Hag wey be Man-United new Oga, as fans boos him off the field after Brighton don beat Man-united 2-0 for first half.

Pascal Gross wey be Brighton player him alone don panel beat United with two goals to nothing just for first half of the match.

Mac Allister for Man-United in 68-minute carry one put inside net for Man-United to make am 1-2, but as the match dey go e too sure say water fit don pass Garri.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *