fbpx
May 5, 2024

Transfer: “I bin no know say letter fit kill person”– Mbappe slam PSG over backlash

mbappe-reply-to-backlash

Paris Saint-Germain superstar, Kylian Mbappe don reply to di backlash wey hin receive after hin send letter to di club.

Di 2018 World Cup winner recently tell di club through letter say hin no get intention to stay for di  club beyond 2024 when hin current deal go expire.

However, di player decision don cause anger for di club, and e lead to mass backlash from PSG, and according to reported, dem make am available for sale dis summer.

PSG no want make di former Monaco man go for free when hin contract run down in June 2024 and their president Nasser Al-Khelaifi dey vex with di striker.

 

FOR MORE NEWS: Osimhen market value don rise to €120m, e break Serie A record

Mbappe yarn say hin bin no expect that kain anger as di aftermath of sending hin letter.

According to transfer expert, Fabrizio Romano, na wetin Mbappe tok be dis, “Honestly, I did not think I was going to offend anyone. I only sent a letter. I didn’t know a letter could kill someone. It’s just a letter. I don’t care about the reactions.”

You fit go read di tori of Mbappe reply to backlash…READ MORE