fbpx
May 5, 2024

Lionel Messi don give only reason why hin still dey play for Argentina

messi-give-only-reason-why-hin-dey-play-for-Argentina

Argentina icon, Lionel Messi don give hin only reason why hin still dey play for di kontri national team.

According to di 35-year-old, hin still be member of di men senior national team simply because dem win di World Cup for Qatar in 2022.

La Albiceleste win di World Cup for di third time in dia history with Messi wey dominate di tournament.

Also, Messi win di World Cup Golden Ball for di second time for hin exploits and hin finish di tournament with seven goals and three assists.

 

FOR MORE NEWS: Transfer: “I bin no know say letter fit kill person”– Mbappe slam PSG over backlash

 

Speaking after Argentina defeat Australia 2-0 for friendly game on Thursday, with Messi and German Pezzella wey enter di scoresheet, di 35-year-old yarn say hin no go dey for Argentine side if to say dem not win di World Cup in 2022.

Na wetin hin tok be dis as All About Argentina quote am, “To be honest, if we hadn’t been the World Champions… I wouldn’t be in the national team anymore.”

You fit go read di tori as Messi give hin only reason…READ MORE