fbpx
May 17, 2024

“Your place on my list is NUMBER ONE” -Mercy Johnson husband dedicate certificate of return to hin wife inside emotional note

mercy-johnson-hubby-write-emotional-note-to-hin-wife

Prince Odi Okojie, di new House of Representatives for Esan South/North East, Edo State don write emotional note for hin wife, Mercy Okojie for her support during hin political campaign.

Di father of four praise hin wife as she be true definition of a supportive wife, wey don lead am to hin success.

Hin tok how dia formidable union don continue to soar, and no be because of dia perfections, but because God get hin eyes on dem permanently.

FOR MORE NEWS: Only INEC Fit Determine How Results Go Dey Collated Or Transmitted – Court

Prince Odi Okojie write emotional note to hin beautiful darling wife Mercy Okojie as hin dedicate hin certificate of return to her.

Inside di note, hin write say words fail am to describe wetin she mean to me over and over again. When hin count hin blessings, her place on top hin list na NUMBER ONE, and nothing or anybody go fit change am.

Also, hin thank di Queen of hin Life for di invaluable support wey she dey always render, for di timeless backing and unending prayers, love, care and everything deserving of man wey dey hin place.

You fit go read di full tori…READ MORE