fbpx
May 18, 2024

Lady block man wey ask her make she cook ogbono for talking stage

lady-block-man-because-hin-ask-her-make-she-cook--ogbonafor-talking-stage-

One Nigerian lady don narrate her funny experience with man wey ask her make she cook Ogbono and egusi during dia talking stage.

According to di Tweet by di lady, she dey talking stage with dia man and dem plan to meet up.

As she send am message to find out which restaurant dem go meet up, hin reply shock her. Di man yarn say hin go give her some money make she use go market instead.

According to am, hin dey hungry for Ogbono and Egusi soup for long time now. Before di man know wetin dey happen, di lady use vex block am as hin still dey type.

FOR MORE NEWS: Naira redesign: Kaduna churches don lose millions as tithes, offerings reduce

Na wetin di lady post for twitter about di man wey want make she cook Ogbono for am during talking stage be dis;

“I bin dey talking stage with dis guy some years ago and we plan to hang out for di first time. I asked am which restaurant we go meet up for lunch and Baba say no oh, hin go send me money to buy foodstuffs, hin dey crave ogbono and egusi soup.

You fit go read di full gist…READ MORE