fbpx
April 26, 2024

“He didn’t deserve that” – Messi criticize Barcelona over Ronaldinho treatment

messi-criticise-barcelona-over-Ronaldinho-treatment

Paris Saint-Germain superstar Lionel Messi don express hin displeasure and hin criticize di manner wey dem treat hin former team-mate Ronaldinho for Barcelona.

Ronaldinho play 207 games, scored 94 goals, and hin provide 70 assists for Barcelona before hin comot for Camp Nou in 2008.

As Messi criticize Barcelona, hin yarn say hin for like am if di Brazilian legend stay for Barcelona for some more years.

FOR MORE NEWS: Tinubu ‘hale and hearty, traveled abroad to rest’ – Keyamo

Speaking with Indian Express, di Argentina captain yarn say di thing wey happen dey ugly. Also, hin yarn say di guy no deserve dat kain thing after everything wey hin do for di club.

“Changing Barcelona’s history. The way he left was very strange, I wish I could have spent a couple more years with him.” Na wetin hin tok be dat.

Ronaldinho comot for di Catalan side and hin join AC Milan immediately Pep Guardiola land for Camp Nou.

You fit go read di tori…READ MORE