fbpx
May 18, 2024

I pay crazy money to bail my papa from kidnappers – Mike Obi

Obi-mikel-share-hin-papa-kidnap-tori-and-di-crazy-amount-wey-hin-pay-to-free-am

Chelsea legend, John Obi-Mikel, don reveal say hin pay some crazy amount of money to comot hin papa, Pa Michael, out of kidnappers den.

Obi Mikel tok dis one when hin dey tok with Dubai Eye 103.8 Sport.

Remember say Pa Michael bin enter di hands of kidnappers along di Makurdi-Enugu road on hin way to one funeral back in 2018 when Obi Mikel bin dey represent di Super Eagles of Nigeria for di 2018 World Cup for Russia.

Mikel Obi bravely lead di Super Eagles against Argentina four hours after hin speak with di kidnappers wey kidnap hin papa.

FOR MORE NEWS: “Present Nigeria to God, ask him to heal our land” – Peter Obi task Christians

According to Mikel, di kidnappers yarn say dem know say him (Mikel) go pay. Also, dem tok say if hin no pay, dem do shoot hin papa.

Hin tok say na horrible experience.

Also, after di game, hin call di kidnappers for phone, negotiate with dem. However, dem bin dey call one kain amount of money. And in di end, hin Obi-Mikel yarn say hin pay some crazy amount of money to carry hin papa comot for there.

You fit go read di full tori…READ MORE