fbpx
May 7, 2024

Governorship election: APC disown Campaign Council lists for Imo, Bayelsa, Kogi

apc-disown-council-lists

Di All Progressives Congress, APC, don comot dia sef from di allege national campaign council lists for November 11, 2023, governorship elections for Imo, Bayelsa and Kogi States wey dey in circulation. As di matter be so, APC don disown di Campaign Council lists for Imo.

Na di party National Publicity Secretary, Mr Felix Morka tok dis tori inside statement on Tuesday for Abuja.

Morka yarn say di lists wey don circulate no come from di party and dem no go regard am.

 

FOR MORE NEWS: Kano Govt slash tertiary institutions’ fees

 

Also, hin tok say dem don call APC attention to di national campaign council lists for the November 11, governorship elections in Bayelsa, Kogi and Imo States wey dey in circulation for sections of di media.

“The lists are not official documents of the party and should be disregarded.” As APC disown di Campaign Council lists for Imo, na wetin Morka tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE