fbpx
May 3, 2024

Mohbad Papa Release Tribute Song for Im Late Son

mohbad-papa-music-tribute

Mr Joseph Aloba, di papa of di late ex-Marlian signee, Mohbad don officially drop music tribute, as e talk about di ogbonge memories wey e share wit im late son.

People bin remember say Mohbad die under circumstances wey be wahala some months ago and e don dey di most controversial report wey happen dis year.

After plenty musicians drop tribute for di late singer, im papa come join di movement, release im first tribute for im late son.

In addition, some part of di song lyrics talk say, ‘Music na di only tin wey I get to remember your memories.’

Di tribute wey Mohbad papa release don yan pipo mind well well as many accuse Mr Joseph say e dey use im son death hustle music career.

Also, Pipo wey react to di tribute wey Mohbad papa release favorbounty talk say: ‘If Bella fit sing tribute for am, why im papa no fit do same?’

 

FOR MORE NEWS: Shettima Tell Universities Say Make Dem Work for National Development

 

boluqueen talk say: ‘So, you wan use your son death cash out…dis man need deal.’

hairbychybrand talk say: ‘Dem need study di way dis man dey mourn because you no fit blow from your son death.’

peaceyinny talk say: ‘Now I sabi why Mohbad dey keep im life private. E know di kind family wey e come from.’

ashani_atelier talk say: ‘E good to express im feelings through song for im beautiful son Mohbad (Rest in peace champ), but wetin I no understand be di part wey e talk say, ‘di only tin wey e go remember about am na Opp Opor pa. Seriously, baba Mohbad, if dis DNA show say Liam na your own, dat boy fit grow hate you. Those wey dey advise you no dey try at all

You fit go read di tori of Mohbad papa music tribute …READ MORE