fbpx
May 17, 2024

“Money no dey enough”: After 102 Children, 67-Year-Old Man don decide say hin no want pikin again.

Money-no-enough

One  67-year-old man, Musa Hasahya, wey dey live for Lusaka, Uganda, yarn say hin no dey interested in growing hin family. Di farmer decision come after hin don already get 102 pikin and 568 grandchildren from 12 wives, Daily Mail reports.

To stop hin family from getting new additions, Musa don instruct hin wives make demstart to dey use contraceptives so that everybody for di family go get food to eat.

According to wetin hin tok, di money wey hin dey earn don reduce well well over di years  because of di rising cost of living and hin family don dey bigger and bigger.”

FOR MORE NEWS: Police don arrest traditional ruler wey burn corpse of 9 years old pikin for Enugu

As di man dey try buttress hin point, hin ask The Sun one rhetorical question.

‘”I married one woman after another. How can a man be satisfied with one woman?” Na di question wey hin ask be that.

All di 12 wives dey live for di same house.

Di 67-year-old man mention say all hin wives dey live under di samee roof so that hin go fit  “monitor” them and prevent instances where some go wan run go meet other men.

You fit go read more of this tori…READ MORE