fbpx
May 17, 2024

Bandits don kidnap 16 pipol for Kaduna community

Bandit don kidnap like Sixteen pipol inside one attack for Anguwan Pa Community, Kajuru Local Government Area of Kaduna State, on Monday.

According to report bandit enter dii community, around 7.30 pm and surround di whole village.

U FIT ALSO READ Police don arrest traditional ruler wey burn corpse of 9 years old pikin for Enugu

Base on di report tori tok say like Fifty-three pipol na hin dem kidnap but 37 of dem na hin escape and return home, yesterday, while like 16 of those captive still dey with dem.

Report tok say dem never get reach to di spokesman of di Kaduna State Police Command, DSP Mohammed Jalige,

Di incident bin happun barely 24 hours after di Christmas Day attack on Angwan Aku inside di same Kajuru LGA, where dey kill one persin and kidnap like 45 pipol join.

According to tori, one middle-aged man, Ifeanyi Okoye, wey dem kidnap two days bifore Christmas, dey don found out say hin don kpai for Awka.

Di state police command don confirm di incident, and di state Police Public Relations Officer, PPRO, Mr Tochukwu Ikenga, tok say e fit no be case of kidnap.

Information show say e fit be cult-related mata base on say dem see say na so so mark of axe cuts na hin dey di body of di persin wey kpai. di PPRO tok say dey don go deposite di dead bodi for mortuary.

To read di full tori CLICKHERE