fbpx
May 17, 2024

Police don arrest traditional ruler wey burn corpse of 9 years old pikin for Enugu

Eluyera-killed-pregnant-wife

Di Nigeria Police don arrest one traditional ruler for Enugu State base on say hin give order say make dem burn di corpse of one 9-year-old house help, Precious korshima.

Di traditional ruler spend hours for Police custody bifore dem later grant am bail.

U FIT ALSO READ Fire burn10 houses on Boxing Day as Lagos records highest fire emergencies

Bifore dem kpai Precious she bin dey work as house help for one Mrs Ujunwa Ugwoke of Fidelity Estate, for Enugu.

According to report Mrs Ugwuoke admit say na she beat Precious to di point of say she kpai for her hand and she con later dump her dead bodi along Enugu-Portharcourt Expressway.

Civil Rights Realisation and Advancement Network (CRRAN), through dia President Olu Omotayo Esq, inside one petition wey dem write to Enugu State Commissioner of Police, tok say di father of di deceased, James Achikpi Korshima, tok say na di villagers burn di dead body.

According to Omotayo, Korshima hin tok say di Police inform am after dey don show face for di scene.

Hin tok say hin hear say di traditional ruler of di community na hin give di order to di youth to burn di dead body base on di kind smell wey di dead bodi dey give

Hin tok aay di traditional ruler don engage himself for illegal act without informing security agents,na wetin no good at all

Korshima don appeal for justice base on say hin dey fear say hin fit no get justice and hin dey frustrated following endless visits to di Anti Kidnapping Base for over one month now.

Hin still dey ask for di release of di remaining of di dead bodi so dat hin go fit give di pikin decent burial.

To read di full tori CLICKHERE