fbpx
May 9, 2024

Super Falcons forward, Oparanozie, retire at 29

super-falcons-forward-announce-retirement

Nigeria Super Falcons forward Desire Ugochi Oparanozie don announce her retirement from football for both kontri and club at di age of 29.

Oparanozie bin dey among di squad wey represented Nigeria for di 2023 FIFA Women’s World Cup wey started for July end for August.

Inside post on Wednesday, on top her X account, wey pipo sabi as Twitter, she write, “To my fans, family, and friends, thank you for di show of love and support over di years. She kon tok say na time to take a bow, as she believe say no better time dey than now.

Also, she yarn say she dey officially announce her retirement from professional football for both club and kontri.

 

FOR MORE NEWS: Shettima go represent Tinubu for G77 summit for Cuba

 

Oparanozie career bin  dey successful career for di Chinese Women Super League and she represent Nigeria national team on different occasions.

She start for Bayelsa Queens and she later play for Delta Queens and Düvenciler Lisesispor.

In 2012, Oparanozie transfer go Rossiyanka for di Russian Women Football Championship.

Also, her tour for there bin dey successful, as she play for di UEFA Women Champions League score one goal. After dat one, she move go VfL Wolfsburg for di Bundesliga for di 2013-14 season.

Super Falcons forward announce retirement, You fit go read di tori…READ MORE