fbpx
May 1, 2024

My Boyfriend leave me becos say i act bedroom scene — Mellisa Osagie

Nollywood actress, Mellisa Osagie, don come out tok say her boyfriend broke up with her base on say she act one bedroom role.

She yarn dis one inside one interview with Saturday Beats, she tok say, “ her boyfriend leave her because say she act one bedroom scene. She con tok say, she dey readi to stay with whoever dey readi to stay and she readi to open door for whoever dey readi to leave.

U FIT ALSO READ Singer 9ice dey celebrate hin 3rd wedding anniversary with hin wife, Sunkanmi.

Mellisa tok say,“ her emotions dey always dey in check. So Whoever is meant for you go surety stay with you.

As an actress, I believe say e go dey better to dey with persin who go understand di business aspect of your career.

She Disagree on di notion wey tok say actresses are usually promiscuous, Osagie tok say, “ di difference beetwin persin wey dey act and regular persin for street na di camera.

Mellisa tok say she bin date one guy for 2017, and dey get issues base on say she dey dey her with her male colleague wey just buy car. and di funniest thing be say dat her boyfriend no dey rich neither did he get a car but she love am like dat.

Wen hin ask am why di change of attitude, naso hin slap her three times after dat statement. but na she just decide not to make am dey public. In order not to be blame bin an not talk about it publicly because say she believe say some people go still blame her base on di fact say shebd actress).”

To read di full tori CLICKHERE