fbpx
April 20, 2024

Na Snapchat filter dem take redesign di new naira note – Sowore blast CBN

0

 

Di presidential candidate for African Action Congress, AAC, Omoyele Sowore on Wednesday, yab President Muhammadu Buhari and di Governor of Central Bank of Nigeria, CBN, Godwin Emefiele, over di newly-redesigned naira notes.

Sowore tok say Buhari and Emefiele don carry Nigerians go where dem no know by redesigning di naira.

U FIT ALSO READ Naira redesign: CBN, banks don ready for transition

According to wetin hin tweet for hin Twitter handle, di AAC presidential candidate “Sowore” tok say oga presido and di CBN governor don dupe Nigerians say dem bi real 419.

As hin sit down for chair, laugh join con tok say him no see any difference for wetin dem do to di new redesigned naira, abi seh dis pipol don deceive Nigerians again.

Buhari wen bi unveil di redesigned N200, N500 and N1000 notes for di beginning of di weekly meeting of the Federal Executive Council (FEC).

Di new Naira notes go become wetin we go dey use buy things for market from December 15, and dem go comot di old ones from ground on February 1, 2023.

Dis na di first time in 19 years wen Nigeria go redesign some of dia currency notes.

According to di photograph wen Sowore share for hin Twitter handle, hin tok say him dey very disappointed on di new development.

Sowore tok say Buhari and Emefiele don use masquerade cover eyes con play Nigerians big time..

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *